8 Signs That You Are A MUGU



1:na mugu u be if u dey pay for a babe school fees or house rent
2:u be mugu if the money meant 4 ur pickins school fees u carry
all the money take am buy brazilian wigs and expensive BBs for ur
girlfriend or girlfriends
3:u be mugu if u steal ur papa money take am buy mary
kay,bleaching cream,lip stick and other expensive gift items for ur
babe on valentine day
4:in short u be mumu,malumalu,olodo,agbaya,ewu,cow etc if u
and ur paddys dey rob bank or stand for highway with guns dey
rob motorists just becos una wan impress una girlfriend wit
money
5:u be mugu plus woman wrapper if u dey wash ur babe dirty
pants and bra(eg sexkillz)
6:na mugu u be if u dey go market for a babe
7:u be mugu if the small money wey u dey earn as salary instead
of u to use the money maintain ursef and ur family u dey take the
money train one small girl for school with the hope say u go
marry her after she graduate.omo wise up my girl many mumu
men don already commit suicide becos the girls wey dey train for
school don dump dem on the marriage alter
8:u be mumu if the main reason wey u dey do yahoo yahoo na to
impress a babe with money